Tuesday, March 23, 2010

NFA! Pay me my money oooo!

The former coach of Super Eagles, Coach Amodu Shuaibu dey vex for NFA (sorry NFF). He talk say them no gree pay am the remaining money wey them be dey owe am.

Na wa ooo, how NFF go arrange another coach wey them never still settle the one wey them demote? Amodu wey first dey vex say after him win Bronze for the last African Nations Cup, them no even pity am, them say make him go dey coach home-based players, them come still add insult on top him injury by not paying am him balance. E don red today!
Okay..I come ask Coachie say how much them dey owe you, the guyman yan me say the money reach One hundred million Naira, na im I open mouth say Shuo!! Upon say you no fit beat ordinary Ghana for Nations Cup. He talk say make I cool down. He come break the money down like this. 30 million Naira na the agreement to qualify Naija to World Cup and him succeed for that side, then the remaining 120 million Naira na for "Breach of Contract". 
My peoples, I no know say money dey for coaching business like this ooo...I wan apply for Assistant to the Assistant coach of the under-age homebased footballers. How una see am?
NFF!! Final warning, pay Amodu him money! Na my uncle and we get hot temper for our family. Una hear??