"But I was DETAMEEN to nefa give up"
Hahaha! LWKMD!
Anytime wey I watch that Peak Milk advert, my belle go just dey tor-torie me...I like Papillo, I no go lie. In fact ehn, na my personal best Nigeria football player be that. After him, na Jay Jay Okocha. Una fit think otherwise, na my own be that.
But the main gist be say Kanu Nwankwo alias Papillo wan produce him own autobiography book and film. The film suppose ready immediately after the World Cup this year and Papillo don talk say he wan use the film take celebrate Naija 50 years Independence. The thing make sense o.
The title of the film na Lion Heart. I wonder which Nollywood actor them go use take act Kanu, shey na Nkem Owoh? (nah, that one suppose be Kanu grandpapa for the film). I no fit wait make the film come out sha..I sure say them Alaba boys sef don dey ready. Wahali, if una pirate this film, na cancer of the chest go hold una and na expired peak milk we go give una chop. Yeye fowl them!!
My people, make una no vex say i dey curse, na as the matter take pain me. Make we talk about Papillo small. Una know say na Kanu be the Most Decorated African Footballer ever? Ironically, this guy no gree score even one single goal for all him African Nations Cup appearances. Na wa for this life!
But na still my mainest man. With him lege-lege leg like tolotolo wey dey learn how to waka so.


No comments:
Post a Comment