When them go free us from all these rumours sef?! Una no dey tire to take us play kalo-kalo?
Anyways, I no go lie for una, I dey gbadun the suspense ooo. For which Nollywood film una fit see enough suspense like this. Abeg make person pass me that pop-corn (sorry, Guguru) make i dey grub as I dey watch.
Na different tory we dey hear unto say our Presido don land. Up till now, we never see the guy himsef for public, no camera don view am and he never take him voice talk to we him peoples. Some peoples dey even yearn say maybe na the guy deady-body them carry come. Abi them wan do him Obito?? Me I no know o..na wetin them talk I dey echo give una so.
As the tory for News don carry K-leg so, na the same K-leg learn I go take yearn una. I see Information Ministress, Auntie Dora Akunyili for 7 o'clock News yesterday and she yearn say Uncle Jonathan must first meet with Turai Yar' Adua before him go know wetin next to do. That one alone come dey make me wonder who Alhaja Turai be for this land, First Lady no be official work na. We no vote for the madam, why her name dey enter News everyday like say na she get the keys to Aso Rock? I don dey vex o..make them no let me voke for them.
The another tory from be say them talk say Alhaji Yar' Adua dey unconscious when them carry am land yesterday morning. I no know whether na true o. But later in the evening, me hear Yar' Adua talk say him never dey fit to enter office. He still wan rest small but make Goodluck still dey there dey enjoy himsef small. He come dey thank we good Nigerians wey pray for am. Make I ask una, how many of una really pray for the guy? Abi na opposite prayer una do sef?
Well, na the tory wey I get be that. Make we dey watch the series dey go. Na Season 2 we wan enter so o.
Before I go, I see one picture wey tortorie me small. Una believe say I been dey think say Bros Goodluck cap no go ever fit commot for him head? I surprise small o...I been dey think say them sow the cap join him head. But as matter hit te guy, him no know when he throway cap commot. LWKMD!!
Later!!

No comments:
Post a Comment