Wednesday, November 3, 2010

Tuesday, March 23, 2010

NFA! Pay me my money oooo!

The former coach of Super Eagles, Coach Amodu Shuaibu dey vex for NFA (sorry NFF). He talk say them no gree pay am the remaining money wey them be dey owe am.

Na wa ooo, how NFF go arrange another coach wey them never still settle the one wey them demote? Amodu wey first dey vex say after him win Bronze for the last African Nations Cup, them no even pity am, them say make him go dey coach home-based players, them come still add insult on top him injury by not paying am him balance. E don red today!
Okay..I come ask Coachie say how much them dey owe you, the guyman yan me say the money reach One hundred million Naira, na im I open mouth say Shuo!! Upon say you no fit beat ordinary Ghana for Nations Cup. He talk say make I cool down. He come break the money down like this. 30 million Naira na the agreement to qualify Naija to World Cup and him succeed for that side, then the remaining 120 million Naira na for "Breach of Contract". 
My peoples, I no know say money dey for coaching business like this ooo...I wan apply for Assistant to the Assistant coach of the under-age homebased footballers. How una see am?
NFF!! Final warning, pay Amodu him money! Na my uncle and we get hot temper for our family. Una hear??

Friday, February 26, 2010

this journey...

Id el' Maloud , I hear say today na Prophet Mohammed (A.S.W). So Merry Mohammedmas to all my muslims brothers and sisters.
Unto the matter today, I dey sure say una dey follow this presidential matter for obodo Nigeria so. But wetin my mind really dey on na to share with una this cartoon picshure wey I see for paper. 

LWKMD! All these our naija cartoonist sef, them own pass Tom and Jerry. This matter pass prayer o...he reach to fast. Shebi 40 days fasting even dey on.I sure say bros Goodluck never miss anyone.
Make we see quick interpretation of this cartoon as according to wetin I see for internet ooo. No be me form am.
Primary School:
Goodluck na Assistant Head boy, the Head boy come die, them promote Goodluck to Head boy.
Secondary School:
Goodluck na Assistant Head Prefect, the pursue the Head Prefect commot for school, them promote Goodluck to Head Prefect.
State Government:
Goodluck na Deputy Governor for Bayelsa State, Governor Alamyiesigah enter gbege, we commot am, we put Goodluck there as Governor.
Presidency:
Goodluck na Vice President, Yar' Adua the president no gree well, we make Goodluck Acting President for now, we still dey watch. 
make we leave the matta for "...to be continued"

Thursday, February 25, 2010

the drama still dey continue...

When them go free us from all these rumours sef?! Una no dey tire to take us play kalo-kalo?
Anyways, I no go lie for una, I dey gbadun the suspense ooo. For which Nollywood film una fit see enough suspense like this. Abeg make person pass me that pop-corn (sorry, Guguru) make i dey grub as I dey watch.
Na different tory we dey hear unto say our Presido don land. Up till now, we never see the guy himsef for public, no camera don view am and he never take him voice talk to we him peoples. Some peoples dey even yearn say maybe na the guy deady-body them carry come. Abi them wan do him Obito?? Me I no know o..na wetin them talk I dey echo give una so.
As the tory for News don carry K-leg so, na the same K-leg learn I go take yearn una. I see Information Ministress, Auntie Dora Akunyili for 7 o'clock News yesterday and she yearn say Uncle Jonathan must first meet with Turai Yar' Adua before him go know wetin next to do. That one alone come dey make me wonder who Alhaja Turai be for this land, First Lady no be official work na. We no vote for the madam, why her name dey enter News everyday like say na she get the keys to Aso Rock? I don dey vex o..make them no let me voke for them.
The another tory from be say them talk say Alhaji Yar' Adua dey unconscious when them carry am land yesterday morning. I no know whether na true o. But later in the evening, me hear Yar' Adua talk say him never dey fit to enter office. He still wan rest small but make Goodluck still dey there dey enjoy himsef small. He come dey thank we good Nigerians wey pray for am. Make I ask una, how many of una really pray for the guy? Abi na opposite prayer una do sef?
Well, na the tory wey I get be that. Make we dey watch the series dey go. Na Season 2 we wan enter so o.
Before I go, I see one picture wey tortorie me small. Una believe say I been dey think say Bros Goodluck cap no go ever fit commot for him head? I surprise small o...I been dey think say them sow the cap join him head. But as matter hit te guy, him no know when he throway cap commot. LWKMD!!
 

Later!!

Wednesday, February 24, 2010

Shey Presido don land ni?

Rumours and Wars of Rumours too dey shele for this our obodo Nigeria sef. We don tire for too many scatta-yan tory. We no even know the one to believe sef!
I just dey gather one rumour say our non-acting presido Alhaji Umaru Musa Yar' Adua don return from Saudi Arabia wey him be sick for the past 3 months. Them talk say na two planes carry the guy come early this morning. One presidential plane and another Air Ambulance plane (so Air Ambulance dey again? how them for take give am First Aid if need be?).
But I come still dey gather another gist say, Alhaji health don even further damage pata-pata. I hear say they even arrange another ogbonge Life Support Machine wey big pass the former one for am. I pray say make the man survive am oo. Him look innocent like person wey no fit kill fly.

Make I first ask una: If na true, shey na Good News or Bad News? Remember say our people dey talk say, One man meat na another man poison. I no go talk pass my mouth.

Tuesday, February 23, 2010

Kanu wan release book and film oooo

"But I was DETAMEEN to nefa give up"
Hahaha! LWKMD!
Anytime wey I watch that Peak Milk advert, my belle go just dey tor-torie me...I like Papillo, I no go lie. In fact ehn, na my personal best Nigeria football player be that. After him, na Jay Jay Okocha. Una fit think otherwise, na my own be that.
But the main gist be say Kanu Nwankwo alias Papillo wan produce him own autobiography book and film. The film suppose ready immediately after the World Cup this year and Papillo don talk say he wan use the film take celebrate Naija 50 years Independence. The thing make sense o.
The title of the film na Lion Heart. I wonder which Nollywood actor them go use take act Kanu, shey na Nkem Owoh? (nah, that one suppose be Kanu grandpapa for the film). I no fit wait make the film come out sha..I sure say them Alaba boys sef don dey ready. Wahali, if una pirate this film, na cancer of the chest go hold una and na expired peak milk we go give una chop. Yeye fowl them!!
My people, make una no vex say i dey curse, na as the matter take pain me. Make we talk about Papillo small. Una know say na Kanu be the Most Decorated African Footballer ever? Ironically, this guy no gree score even one single goal for all him African Nations Cup appearances. Na wa for this life!
But na still my mainest man. With him lege-lege leg like tolotolo wey dey learn how to waka so. 


"Papillo, I know say one day, you go make us proud"

 In fact! Grab ya copy now!!

Friday, February 19, 2010

Nigerian don buy Airport ooo!!

My country peoples. This one no be small something ooo. While we dey here dey find our "non-acting" Presido, one of our brothers don do something for airport o. Make una no shake, no be another Mutallab be this. This time around. This Naija man, Mr. Adebayo Ogunlesi wey dey obodo disapora don arrange on big airport. The name of the airport na Gatwick Airport. 
Una wan know how much him buy am?? Na 1.5 Billion Pounds. Chai!!
 


This man na 56 years old and him be the oga pata-pata of one investment company, Global Infrastructure Partners (GIP) wey dey for New York. Correct. Make them dey hear our name for better development. 
Abi, how una see am?
Oga Ogunsele, do make you come collect Chieftaincy title, if you no fit come, no worry, we go send am over. NDU! (Nothing Do You!)